Friends and family no fit hold dia tears as dem bury legendary ex-Nigerian goalkeeper Peter Rufai on Friday 22 August…..CONTINUE FULL READING>>>>>
Na for Ikoyi Cemetery for Lagos, southwest Nigeria, dem bury Dodo Mayana as pipo dey call am.
Di legendary goalkeeper die on Thursday 3 July at di age of 61.
Reports say Rufai bin sick for some weeks, bifor e give up di ghost for one hospital for Lagos.
Super Eagles for dia post on social media hail di legendary goalkeeper say e go dey “forever in our hearts”.
For di burial, former Super Eagles defender Taribo West express anger sake of di treatment wey Rufai bin get.
E criticise di Nigerian govment and football authorities for di kontri sake of say Rufai’s family gatz beg for funds to give di former goalkeeper correct burial.
Photos from di burial